Sponsored Advertisements

Greedy man. What woman can not do does not exist madam thank you jor!

Spirituality & Religion 61 days ago Participants (0)
  • Thread Thumbnail

    On top broken tiles wey you been throway haba! I see broken tiles for your backyard, I come knock your gate you send your pikin make him come check. I ask your pikin wether you or your wife dey? Him say yes, before I go say tell your papa, you come show,  as I greet you finish.

    I explain why I come. I ask you wether, I fit pack the break break tiles wey wuna troway aside. You say make I bring money, I ask you how much? You say 20k I  come ask you wether na joke? You tell me say, you dey serious ok. I come ask again wether you get sack wey you go measure am? you come tell me say, na me go pack am say no need for measurent.

    Say the quantity na 15k last and na me go provide sack.  Hmmmm,, na him I tell you say, I no fit pay 15k because, even for measurent e no go reach 5bag.  you come say ngwanuu bye bye! As  you talkam finish, God of women helping women no dey sleep gbam! Your wife come come outside come dey call me madam! Wait! She start to the talk to you before i go turn, quarrel start between husband and wife ooo.

      I no talk because the thing come dey sweet me small small, naso your wife come say, madam pakam! Pack everything wey dey there no mind this greedy man. Something wey we dey find who go throway ram since 

    As I hear come packam na so I rush go carry big basin begin to packoooo wetin concern me? 

Comments (0)

  • Be the first to comment!

Leave a Reply

Maximum file size: 1MB. Supported formats: images (JPG, PNG, GIF, WEBP) and PDF only.

New Discussions