Sponsored Advertisements

***This Thing Dey Tire Person***

General 119 days ago Participants (1)
  • Cherrysweets

    **This thing dey tire person 😩**

     

    You go post something reasonable – no views, no likes, no comment. But everybody dey expect their own post to go viral. How?? You no support another person, but you want make dem support you. 🤷🏽‍♀️

     

    Some people no even dey active, but dey expect magic $ to enter their wallet. This Konnect self, if you no dey play the *“like and comment game”*, nothing dey move.

     

    Me I tire. 😤 Hardworking people dey get ignored, while lazy scrolling people dey chop reward. E no balance abeg.

     

    Let’s just be real — support each other or make everybody just park well. This platform no be miracle ground. Na effort dey pay, not silent prayers.

     

    #JustSaying #FrustrationReal #OnlineHustleNoBeBeans

Comments (1)

Leave a Reply

Maximum file size: 1MB. Supported formats: images (JPG, PNG, GIF, WEBP) and PDF only.

New Discussions