One time, one guy wey dem dey call Sly dey waka for street with slipper wey don nearly turn bathroom rug.
People go look am, laugh small, then waka pass.
Dem no sabi say that same Sly dey carry big dream for head like gele.
Every morning, e go dey sit for junction with one small book dey write ideas business, quotes, even motivation wey fit ginger soldier.
One aboki wey dey sell suya near am one day ask, “Bros, why you dey always dey write?”
Sly smile say, “Na my own way to prepare for better day.”
Fast forward 2 years that same Sly don open small shop wey dey do graphic design and online work.
The same people wey laugh am that time now dey ask,
“Omo, how you take do am?”
E tell dem, “I no wait make life sweet before I start. I use bitter moments take prepare sweet future.”
Moral of the story:
No underrate anybody wey dey hustle silently.
And no underrate yourself because your today no shine light dey come.
If this story touch you small, make you drop one fire emoji 🔥.Who know? Your own story fit dey cook too. 💯
#LifeStory #Inspiration #StayHustling #TracyvickOnKonnect
Only smart 🤓 people can know this Read more
No matter where you school, these foods are life-savers: 1. Indomie – emergency fuel 2. Bread & egg – portable … Read more
😂 Nigerians: “I’m coming” = I haven’t even left my house 😭 Thread 🧵👇 1. “Let me just branch small” … Read more
😴 Sleep? Never heard of it. Welcome to the #NoSleepGang — the wildest trend keeping Gen Z Nigerians up all … Read more
“Abeg who else don delete messages before person see am? 😂” Read more
Angelic Beauty
Michael
Penvibe
Oscar
Tracyibe
46 days agoOne time, one guy wey dem dey call Sly dey waka for street with slipper wey don nearly turn bathroom rug.